Naijapals Mobile

Or Please Join Naijapals! or Login
← Back | Music Library

Dem mama / timaya


Play / DL → ( 170604 plays)


INTRO
I say they done come [iyo (x6)]
Nothing we do them [iyo (x6)]

VERSE 1
Nigeria na my country oh
Bayelsa na my state oh
This na reality
Well e bin happen for Bayelsa oh
Nineteen Ninety nine oh
I swear I no go forget am oh
When them kill the people oh
And they make the children them orphans oh
Any time wey I think am oh
Water dey pour from my eyes oh
Somebody say make I leave am oh
But I say me I must talk am oh

CHORUS
I say them don kill them mama eh [eh eh]
Them don kill them papa eh
I say them don kill them mama
them papa them mama them papa them mama eh
I say they done kill them mama eh them papa eh ah
them mama eh ah
Wetin we go do iyo
Do iyo
Say do iyo

VERSE 2
Na so them march dey go iyo
Ten thousand soldiers for road iyo
Ask them where them dey go
Them say them dey go Bayelsa oh
Which place for Bayelsa
One village they call Odi oh
Na im them enter our village
and rape our young girls
And make us homeless oh [chai]
Them kill our mama iyo
Them kill our ppaa iyo
Them kill our brothers
Them kill our sisters
And make us homeless oh
Wetin we go do iyo
Do iyo
Say do iyo
Everybody dey cry oh
I say Government them bad oh

REPEAT CHORUS

VERSE 3
I don die oh
Poverty no good at all oh [chai]
Everyday for Nigeria
Na so the people them dey die oh
Eeeehhh, our government oh
Na why una make us dey cry oh
OOooh, everyday for Nigeria
Na so the people dem dey die oh
Them commot for house for morning oh
Money no dey for your hand oh
Police go stop you for road
Them go collect the one wey you get oh
Them lay allegation for your head oh
For wetin you no do iyo
Before you go know
My brother, you don dey inside cell oh

REPEAT CHORUS


Copy Link:


rating: 3 stars/78 ratings





Comments:

~ 17 years ago frankie2379 said:
love dis jam
naija....we r goin places.....nutin for dem mama.
...

~ 17 years ago lennie_079 said:
like dis guys style
Am in love with dis kind of music,its different from the rest.

~ 17 years ago sebra1love said:
Heyyyyyyyyyyyyyyyyyyyy
the music is just too much i pray what follows is as well good as this cause people dont play with this track at all i love it guyyyyyyyyyyyyyyyyyyy yyyssssssssssss keep it uppppppppppp

~ 17 years ago devid75 said:
bros
povertiy no good at all i remember does days for naijai

~ 17 years ago smithsandys said:
Dem mama
although i dey na cameroon i di enjoy niaja jam past all thing.naijazzzzzzzzzz make who na keep up

~ 16 years ago kamalgadanya said:
dennnn mmmm
i luv d sonnnnng....

~ 16 years ago Adikpe said:
wonderful dem mama
dem mama is wonderful song indeed. wen eva am plyng, it gvs me joy n i feel iray. Wonderful song indeed!

~ 16 years ago megamade said:
obasnjo mama
Its d bomb,......great music men.....timaya na d highest...saw him in italy and i trip for d dude badly cos him too fine....keep d fire cos u dey hot like fire.....shine my bro cos na ur time men!

~ 16 years ago whereluv said:
omo eno easy
thankgod i no dey 9ja again , i det live my dream for yanki.......where dreams are possible....gba bee

~ 16 years ago prince456 said:
prince
timaya me a don go yanki to fulfil my dreams

← Previous  |  Next →

Add Comment

Please Login To Add Comment
NP mob 2009 - 2025. Full site - T: @naijapals - F: Naijapals - Whatsapp