![]() Login With Facebook Or Please Join Naijapals! or Login
← Back | Music Library
Play / DL → ( 170610 plays)INTRO I say they done come [iyo (x6)] Nothing we do them [iyo (x6)] VERSE 1 Nigeria na my country oh Bayelsa na my state oh This na reality Well e bin happen for Bayelsa oh Nineteen Ninety nine oh I swear I no go forget am oh When them kill the people oh And they make the children them orphans oh Any time wey I think am oh Water dey pour from my eyes oh Somebody say make I leave am oh But I say me I must talk am oh CHORUS I say them don kill them mama eh [eh eh] Them don kill them papa eh I say them don kill them mama them papa them mama them papa them mama eh I say they done kill them mama eh them papa eh ah them mama eh ah Wetin we go do iyo Do iyo Say do iyo VERSE 2 Na so them march dey go iyo Ten thousand soldiers for road iyo Ask them where them dey go Them say them dey go Bayelsa oh Which place for Bayelsa One village they call Odi oh Na im them enter our village and rape our young girls And make us homeless oh [chai] Them kill our mama iyo Them kill our ppaa iyo Them kill our brothers Them kill our sisters And make us homeless oh Wetin we go do iyo Do iyo Say do iyo Everybody dey cry oh I say Government them bad oh REPEAT CHORUS VERSE 3 I don die oh Poverty no good at all oh [chai] Everyday for Nigeria Na so the people them dey die oh Eeeehhh, our government oh Na why una make us dey cry oh OOooh, everyday for Nigeria Na so the people dem dey die oh Them commot for house for morning oh Money no dey for your hand oh Police go stop you for road Them go collect the one wey you get oh Them lay allegation for your head oh For wetin you no do iyo Before you go know My brother, you don dey inside cell oh REPEAT CHORUS Copy Link: rating: 3 stars/78 ratings Tweet Comments:~ 16 years ago
ade477 said: Simply GREAT!!! Love it so much can't stop dancing with my daughter....LOL!!! ~ 16 years ago
emeka18277 said: Na Dem Mama tru tru Its so so good.D music just dey fly high all over India.I beg una to keep it up.My love is with niaja music.all my respect to TIMAYA & R+U+GG+U+DEE BABA ~ 16 years ago
neroken said: dem mama timaya u too much na bayelsa i do my youth service ur state too much ~ 16 years ago
maxen said: Timaya... u too much Keep it up. Posterity will tell. The history u hv recorded will remain evergreen. Niger Delta will survive! ~ 16 years ago
Teami said: Inspiration Dis song 2 much, it shows de evil agenda of Obasanjo who no care 4 dem mama, de way he eliminate Fela mama. Add CommentPlease Login To Add Comment |
Follow @Naijapals |