![]() Login With Facebook Or Please Join Naijapals! or Login
← Back | Music Library
Play / DL → ( 170612 plays)INTRO I say they done come [iyo (x6)] Nothing we do them [iyo (x6)] VERSE 1 Nigeria na my country oh Bayelsa na my state oh This na reality Well e bin happen for Bayelsa oh Nineteen Ninety nine oh I swear I no go forget am oh When them kill the people oh And they make the children them orphans oh Any time wey I think am oh Water dey pour from my eyes oh Somebody say make I leave am oh But I say me I must talk am oh CHORUS I say them don kill them mama eh [eh eh] Them don kill them papa eh I say them don kill them mama them papa them mama them papa them mama eh I say they done kill them mama eh them papa eh ah them mama eh ah Wetin we go do iyo Do iyo Say do iyo VERSE 2 Na so them march dey go iyo Ten thousand soldiers for road iyo Ask them where them dey go Them say them dey go Bayelsa oh Which place for Bayelsa One village they call Odi oh Na im them enter our village and rape our young girls And make us homeless oh [chai] Them kill our mama iyo Them kill our ppaa iyo Them kill our brothers Them kill our sisters And make us homeless oh Wetin we go do iyo Do iyo Say do iyo Everybody dey cry oh I say Government them bad oh REPEAT CHORUS VERSE 3 I don die oh Poverty no good at all oh [chai] Everyday for Nigeria Na so the people them dey die oh Eeeehhh, our government oh Na why una make us dey cry oh OOooh, everyday for Nigeria Na so the people dem dey die oh Them commot for house for morning oh Money no dey for your hand oh Police go stop you for road Them go collect the one wey you get oh Them lay allegation for your head oh For wetin you no do iyo Before you go know My brother, you don dey inside cell oh REPEAT CHORUS Copy Link: rating: 3 stars/78 ratings Tweet Comments:~ 16 years ago
duruebuka said: friends hey what a crazy sweet time u make people go, people say u r the best and i like u,dont give chance to them ok continue u good job.thx duruebuka. ~ 16 years ago
ebipeter said: hi timi keep the flag flying GOD is watching and.................. ..................... ..... ~ 16 years ago
irisyes6 said: 9ija 4 reai no worry becos we no go worry nice memory,good history keeping i love u ~ 16 years ago
oseodion said: Na so this one is a good one de dom kill dem mama, it remember me of the past of the niger deltal, haillings my pal you too much keep on your good songs: ~ 16 years ago
victornice said: history İs alabout history hope they will change and leav4 good and do the right things,we need more of someone like them Add CommentPlease Login To Add Comment |
Follow @Naijapals |