Naijapals Mobile

Or Please Join Naijapals! or Login
← Back | Music Library

CELEBRATE / WOLE SENTIMENTA & Da UPTIMIST BAND


Play / DL → ( 14110 plays)


Celebrate ...Because you dey alive Celebrate ...Because I dey alive I go jubilate “everybody say” ...Shout halleluiah I dey alive today People dey for mortuary I no fine pass them Glory be to God eni s’oju mi o eeh eh eeeh o s o eeh ...Se you go follow me waka, make we go to somewhe Una go follow me make we go to krikiri, somany innocent dey there wey dem jail for live, So many innocent dey there wey dem sentenced to death And you sit down there so so complain about money And you sit down there so so complain about business Una go follow me waka make we go to general hospital somany people dey there water dem no go fit drink ordinary food dem no go fit chop, and you sit down there so so complain about clothing that’s why say ...deadbody no dey wear sokoto I go celebrate ...Deadbody no dey no find money I jubilate ...I never see dead body wey do business I go celebrate, everybody say ...Shout hallelujah I dey alive today People dey for mortuary I no fine pass them Glory be to God eni s’oju mi o eeh eh eeeh o soju mi o eeh ....Celebrate, I go jubilate Shout hallelujah I dey alive today People dey for mortuary I no fine pass them Glory be to God eni s’oju mi o eeh eh eeeh o soju mi o eeh ...Some dey vex with God say dem no get money Some dey complain say dem no get motto Some dey vex with God say dem no get piken Some dey para for government say dem no get job Government self no dey send them if dem like make dem hang You hustle for decade yet to become a land lord Babe you don ripe for marriage no one to say I love you Everybody get one reason or the other just to complain My brother, if life dey, hope dey, try to dey appreciate That’s why I say ...dead body no dey look for work I go celebrate ...dead body no dey fix lace-wig I go jubilate ... never se dead body wey dey drink Hennessy I go celebrate ...Everybody say Shout hallelujah I dey alive today People dey for mortuary I no fine pass them Glory be to God eni s’oju mi o eeh eh eeeh o soju mi o eeh ...Celebrate, I go jubilate Shout hallelujah I dey alive today People dey for mortuary I no fine pass them Glory be to God eni s’oju mi o eeh eh eeeh o soju mi o eeh ...Se la joma jo l’amodun ni oo beremole ko gbesoke ... while i dey sing you go dey dance


Copy Link:






Comments:

~ 10 years ago SENTIMENTA said:
CELEBRATE
AS A HUMAN, EVERYBODY HAS ONE REASON OR THE OTHER TO COMPLAIN COS MOST COMPLAINS BASE ON, MONEY, JOB, CAR, HOUSE, WEARS, HUSBAND, WIFE, GIRLFRIEND, BOYFRIEND, BUSINESS, GOVERNMENT, CHILDREN OR CHILDLESSNESS. BUT HAVE YOU THOUGHT OF PEOPLE IN THE MORTUARY?
CAN THEY THINK OF ALL THESE YOU BRAKE YOUR HEAD FOR.
DO YOU KNOW THOUSANDS OF INNOCENT PEOPLE IN JAIL AND LOTS IN SEROUS PAIN ON THE HOSPITAL BED ?
BUT YOU ARE OUT THERE WITH TOTAL FREEDOM AND SOUND HEALTH.
NOW U SEE YOU HAVE EVERY REASON TO CELEBRATE.

I CREATED THIS MUSIC FOR YOU TO CELEBRATE YOURSELF,
IN EVERY SITUATION
WHILE YOU ARE HAPPY OR NOT.
SENTIMELOOOOOOO

Add Comment

Please Login To Add Comment
NP mob 2009 - 2024. Full site - T: @naijapals - F: Naijapals - Whatsapp